# Memes πŸ˜‚ **Published by:** [Daily news,stories and memes](https://paragraph.com/@cgefilms/) **Published on:** 2025-10-13 **URL:** https://paragraph.com/@cgefilms/memes-%F0%9F%98%82 ## Content My memes 😝 – When My Mama Hear Say I Don Turn Father πŸ˜­πŸ˜‚ After that day wey the girl tell me say she don carry belle, I reason say make I just chill β€” maybe na prank. Two weeks later, she call me again: β€œBabe, I wan go greet your mama.” Me: β€œπŸ˜³ Which mama? My mama wey still dey call me β€˜small boy’? You wan give am heart attack?” Before I fit block her plan, this girl don waka go my mama shop for Mile 3. She greet my mama say, β€œMama good afternoon, na me your daughter-in-law o.” My mama just dey look am like say na movie. She ask, β€œDaughter-in-law from which house?” The girl smile say, β€œFrom your son Noble na… I carry him baby.” 😭😭😭 Mama faint small, come wake up shout, β€œJesu! Noble! You don give person pikin belle?!β€πŸ™‡ Before I even reach house, neighbors don gather, one woman don shout, β€œNa so this our pikin don join fatherhood gang!” πŸ˜‚πŸ˜‚ Since that day, my mama dey call me β€œPapa Junior” even though the baby never reach three months inside belle 😭 Now anytime I pass Mile 3, boys go hail me, β€œBaba Junior! You no ready for fatherhood but fatherhood ready for you!” πŸ˜‚πŸ˜‚ Abeg if u never follow up try now ooo 😍 I gat u guys covered ds days πŸ˜‚ πŸ‘‰πŸ‘‰πŸ‘‰ CGE Films πŸ’ͺ🫢 ## Publication Information - [Daily news,stories and memes](https://paragraph.com/@cgefilms/): Publication homepage - [All Posts](https://paragraph.com/@cgefilms/): More posts from this publication - [RSS Feed](https://api.paragraph.com/blogs/rss/@cgefilms): Subscribe to updates