My memes ๐ โ When My Mama Hear Say I Don Turn Father ๐
After that day wey the girl tell me say she don carry belle, I reason say make I just chill โ maybe na prank. Two weeks later, she call me again:
โBabe, I wan go greet your mama.โ
Me: โ๐ณ Which mama? My mama wey still dey call me โsmall boyโ? You wan give am heart attack?โ
Before I fit block her plan, this girl don waka go my mama shop for Mile 3. She greet my mama say,
โMama good afternoon, na me your daughter-in-law o.โ
My mama just dey look am like say na movie. She ask, โDaughter-in-law from which house?โ
The girl smile say, โFrom your son Noble naโฆ I carry him baby.โ
Mama faint small, come wake up shout, โJesu! Noble! You don give person pikin belle?!โ
Before I even reach house, neighbors don gather, one woman don shout, โNa so this our pikin don join fatherhood gang!โ ๐๐
Since that day, my mama dey call me โPapa Juniorโ even though the baby never reach three months inside belle
Now anytime I pass Mile 3, boys go hail me,
โBaba Junior! You no ready for fatherhood but fatherhood ready for you!โ ๐๐
Abeg if u never follow up try now ooo ๐ I gat u guys covered ds days ๐
๐๐๐ CGE Films ๐ช
